Monday, 14 December 2020

Nigerian artistes and entertainers don begin raise voice in support of dia colleague Omah Lay, wey authorities hand cuff and remand for prison Read on Tafia world

 


Omah Lay




Nigerian artistes and entertainers don begin raise voice in support of dia colleague Omah Lay, wey authorities hand cuff and remand for prison ontop accuse say e break dia Covid-19 rules.

Laycon, recent winner of di Big Brother Naija TV show, award winning musicians Teni, Sound Sultan, follow ask questions after Uganda Police charge Omah Lay, and two oda Nigerians wey go di East African kontri to perform for one concert.

Stanley Omah Didia alias Omah Lay, Temilade Openyi alias Tems and Muyiwa Awoniyi appear for Magistrate court on Monday 14 December ontop charge of "negligently doing acts wey fit spread infectious diseases".

"Why dem no shut down di [show] before e happun?," Laycon bin ask even as anoda Nigerian celebrity Sound Sultan para say na di promoters of di show Uganda authorities suppose dey face accuse.

Burna Boy, di two-time Grammy nominee sef chook mouth for di mata.

Omah Lay on Monday afternoon, post for Twitter wia e ask why Uganda goment dey use im mata take play politics.

Already, some pipo don dey call for Nigerian artistes to boycott di MTV Africa Music Awards (MAMA) wey suppose hold for Uganda capital Kampala in few months time.

No comments:

Post a Comment